Duration 2:13

Barnz Agev - Hope Dey

6 607 watched
0
292
Published 27 Sep 2020

Sometimes life be like Mike Tyson, e go throw u punches wey u no fit dorge Sometimes e be lk say death b d best option But the only hope be say everything get expiring date So anything wey person dey go through one day e go end I no know exactly which day, but I just know say e go end Bcus Life dey in stages, stages get process E fit be say wetin u dey go through na process wey God dey use build u But e no go easy Some nights u go wet pillow with tears Friends and families go insult u, ur friend wey dn make am them go dey use him life show u as example, and that kind thing the pain eh No forget say person wey d cook indomie go chop before person wey d cook beans, but na who d food go stay for him belle longer na it be d question Me I just blv say pain na process for life Oyibo man talk say "no pain no gain" So if u dey go through hard times and u still dey alive, e means say hope dey for u, the process go finish, believe me, u go see better tin for this life This talk so,e get why. #motivational #inspirational #nigeria #Realtalk #9ja #pidginEnglish #hope #spokenwords

Category

Show more

Comments - 18